Nigeria Labour Congress NLC and di Trade Union Congress TUC don suspend dia strike wey suppose start tomorrow sake of scarcity of naira.


NLC President, Joe Ajaero say di decision na afta dem receive briefings from dia state councils wey dey di 36 states and Abuja.


Di planned stay-at-home for start Wednesday 29 March sake of naira and fuel scarcity including electricity tariff increase wey dem say gomment no address.


Ajaero draw warning say NLC go resume di protest if naira notes no dey available again to Nigerians by di end of two weeks.

Comments